
Iran don accuse US say dem dey pretend after Mike Pompeo wey be US secretary of state say na Iran spoil drone attack for two Saudi oil facilities.
Iran foreign minister say as dem blame Iran no mean say the disaster go end.
Saudi Arabia say the strike wey happen on Saturday make dem to postpone production of 5.7 million barrel of oil. People go dey chook eye for the market as sabi people dey expect say price go go up.